'My journey wit Ghana national team end' - Black Stars forward Inaki Williams announce retirement

Ghana player on di pitch

Wia dis foto come from, Justin Setterfield/Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Inaki Williams wey be one of di solid forward for Black Stars of Ghana don announce im retirement from di national team.

Di Athletic Bilbao star say im journey wit di Ghana national team come to an as im don give evritin to di team.

Inaki announce dis for im X page on Friday afternoon 11 September, 2026 wia e add say im dey comot di national team proud and happy.

"I feel di time don come to bring my journey wit di Ghana national team to an end. I leave happy, proud and wit di peace of mind of knowing say I give evritin evri time I wear dis shirt," Inaki tok.

Inaki still play for di Black Stars of Ghana for di 2026 Fifa World Cup wey just end wia dem no really go far.

Ghana comot for di 2026 Fifa World cup afta dia 1-0 disappointing defeat to Colombia, despite say dem enta di game wit plenti confidence afta dia performance against Panama and England for di group stage when dem bin keep two clean sheets.

Inaki Williams first announce im decision to represent Ghana for 2022, ahead of di 2022 Fifa World Cup.

Inaki first hope say im go play for Spain but later on, na Ghana e later play for.

"Ghana don give me plenti wey dey more dan football. E don allow me to come back home, feel even closer to my roots and experience di enormous pride of representing my kontri and wearing dis flag for my chest.

Inaki say im go kontinue to dey support Ghana football and di Black Stars.

Bifor get en first international call up to represent Spain under-21 squad in March 2015.

Despite say e play for Spain junior national team, e no make major competitive appearances for dia national team side.

Who be Inaki Williams

Inaki Williams be professional footballer who dey play for Atletico Bilbao in de La Liga.

Born to Ghanaian parents, wey enter Spain by crossing de Sahara desert on foot and jumping over de Melilla border fence, Williams spend most of en childhood developing en football talent.

At de age of 18, Atletico Bilbao spot him wey dem sign him to dia youth team.

He make en first team debut in de La Liga in 2014 for Atletico Madrid, get en first goal de following year February.

Years later, de young talent establish himself as key player in de senior side leading Atletico to major wins including 20 meter goal against Barcelona in de Spanish Super Cup final.

International career

He get en first international call up to represent Spain under-21 squad in March 2015.

Despite playing for Spain junior national team, he no make major competitive appearances in dia national team side.

In 2021 when dem ask am about de possibility of playing for Ghana he talk say "my parents dey come from Accra, dem no born or raise me there, my culture dey here."

But on July 5, 2022 he make u-turn on en decision to represent Ghana by wearing de Black Stars ahead of de 2022 Fifa World Cup.

For 2019, di Athletic Bilbao striker Inaki Williams sign nine-year contract wit di Spanish club.

Williams sign until 2028 and im new deal include 135m Euro (£125m) release clause.

Di contract na one of di longest eva wey a player go get but e no pass di 10-year agreement weyReal Betis give Brazilian winger Denilson for 1998.

Afta e fail to get call up to di Spanish senior squad, Williams switch allegiances to di kontri of im parents, Ghana wia e make im debut for di 3-0 friendly defeat by Brazil for September 2022.

Williams start all three matches for Qatar 2022 but fail to score as Ghana comot for group stage afta di 2-0 defeat by Uruguay.