Wetin we know about deaths of residents for Ondo State as authorities launch investigation

A man wearing face cap sits on a chair and stares ahead

Wia dis foto come from, Hon. Lucky Orimisan Aiyedatiwa/Facebook

Published
Read am in 2 mins

Di Ondo State Ministry of Health don launch investigation into report of sudden and unexplained deaths for parts of Odigbo local govment area of di state, afta di deaths of more dan 30 pipo as odas dey hospital.

Dem report di deaths for several communities, including Odigbo town, Newtown and Orita, bifor similar reports show face from Araromi-Obu, wia some pipo kpai and some land for health facilities.

Na di Ministry of Health for di state make di informate for dia official Facebook page on Thursday, 10 September.

Di Commissioner for Health, Dr Banji Ajaka, say di govment neva establish di exact cause of di deaths but say preliminary findings don rule out viral and bacterial infections.

E say di report wey di investigation team receive suggest say di victims fit don consume alcohol mixed wit unidentified substance or concoction bifor dem start to fall sick.

Ajaka say dem neva confam di substance scientifically as di cause of deaths.

"We neva confam di source of death," e say and add say investigation still dey go on.