BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Why Dangote dey sell shares of im refinery and how e go benefit Nigerians?
Dangote tok say e wan for di pipo wey no too hold money like dat to fit be shareholders of di refineries.
Why schools dey lockdown for Cameroon as new academic year dey start
Di lockdown don also affect economic activities and movements for di English-speaking regions.
How Nigeria help reconcile former Sierra Leone President Koroma wey dey exile since 2024 wit current govment
More dan two years afta e run comot for Sierra Leone sake of accuse say e plan coup, Ernest Bai Koroma don return to im kontri following diplomatic intervention.
Five pipo kpai as Amazon cargo plane crash for Miami airport
Five pipo don kpai and five seriously injure afta one Boeing 767-300 cargo plane "overrun" di runway and catch fire, officials tok.
Ogbonge TV presenter dey among di 12 pipo Egypt sentence to death for drugs case
Sarah Khalifa na popular TV show host for Mission Impossible, wey dey deal wit crime issues.
Wetin di different world maps get right - and wetin dem get wrong
As di UN adopt a new world map to reflect Africa true size, make we take closer look at wetin different maps get right and wrong.
Meet di 28 governorship candidates of opposition ADC for 2027 elections
Di party wey be like di main opposition for Nigeria now get ogbonge pipo like former Attorney General of Nigeria, Abubakar Malami and former Lagos State govnoeship candidate for Labour Party Rhodes Vivour as dia candidates.
March and March protesters clash wit foreign nationals for South Africa, pipo injure
Na officer of di South African Police Service try stop di figh afta some members of March and March movement sustain injury
Wetin be Nigeria relationship wit Niger as Tinubu govment deny say dem back failed coup
Nigeria describe di claims as baseless, irresponsible and a deliberate attempt to misinform di public and tarnish Nigeria image.
Special Tori
Tanzanian president Samia Hassan lose husband
Vice President Deogratius Ndejembi make di announcement on Monday, 7 September.
Why Kenya dey crackdown on foreign traders and small retailers
Kenya President Willliam Ruto set Monday, 7 September as di deadline for foreigners wey dey operate small-scale businesses to stop to dey work.
'Di crowd shout say we tiff pesin penis' - how deadly rumours spread on social media
More dan 80 pipo don kpai sake of mob violence, di BBC find after dem gada data from six African nations.
Deadi bodi of Uganda youngest king wey die at 34 land from US for burial
Family, friends and govment officials receive di deadi bodi of di 34-year-old king wey arrive for Entebbe Airport on Friday, 4 September.
Uber, GSK, ShopRite and oda foreign companies wey don comot for Nigeria - why dem dey leave?
Hia na list of ten companies wey don comot for Nigeria in di past five years.
Senator Sharafadeen Alli campaign organisation react to viral video of govnorship candidate wit students wey dey make Nigerians tok
For inside one viral video, Senator Sharafadeen Alli, wey currently dey represent Oyo South Senatorial District for di National Assembly, carry one student for leg during one interview.
'We make difficult decision’ - Uber tok why dem shutdown operations for Nigeria
Uber say na very difficult decision for dem to comot from Nigeria but dem gatz do am sake of dia 'business priorities'.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































