Cameroon end Nigeria dominance for Wafcon wit 1-0 victory

Wia dis foto come from, Adekunle Ajayi via Getty Images
Nigeria Super Falcons don crash out of di 2026 Women Africa Cup of Nations afta dem lose to rivals and neigbours Cameroon 1-0.
Di Super Falcons no too play well for di first half wey Cameroon dominate.
Cameroon wey begin put pressure from di blast of di whistle score di only goal for di 19th minute from freekick.
For di second half, di Falcons come out wit all di force nad energy, diem dey fire shot from all areas but di Cameroon goalkeeper Michealy just dey catch all di ball and save all di shots.
As e be so, Nigeria wey be di defending champion and 10 time winners don end dia journey.
Cameroon don get automatic qualification for di 2027 Fifa World Cup.
Match highlights
Second Half
Full Time Cameroon 1-0 Nigeria
90+8 Referee don blow whistle, match don end as Nigeria crash out.
90+8' Nigeria dey push for di few seconds wey remain but e be like say water don pass garri.
90+5 Tension for Nigeria camp as di clock dey tick down wit evri second no goal for Nigeria yet.
90+3 Miss! Esther Okoronkwo miss beta chance to score for Nigeria for open net, she make beta run but di ball roll go corner of di post.
90+2 Substitution for Nigeria, Jennifer Echegini don comot and Asisat don enta.
90' Referee add 7 minutes.
85' Cameroon play am but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie punch am go cornerkick,dem play di corner again but defenders clear di threat.
83' Cameroon no gree for Nigeria o, freekick for di Lionesses afta foul from Nigeria defender Osinachi Ohale.
Cameroon 1-0 Nigeria
80' Na 10 minutes of regular time remain and Nigeria must try hard to score if dem want get anytin from dis match.
80' Anoda strike from Nigeria but Cameroon goalkeeper catch di ball again!
78' Cameroon still dey lead as Nigeria dey find goal wey be like say e hard too come.
76' Nigeria get chace toscare again but Cameroon goalkeeper jum catch di ball again.
74' Di match dey hot as e dey enta di dying minutes, as Nigeria still dey find goal.
72' Cameroon player don comot from field wit stretcher, Nguleru don replace her. 70' Save! Cameroon goalkeeper Michaely save Nigeria goal attempt wit one hand, dis Cameroon goalkeeper fit save anytin.
69' Esther Okoronkwo of Nigeria dribble two Cameroon players for di goal area but Nigeria players no understand.
66' Freekick for Nigeria afta Cameroon player foul Nigeria player near di goal area, Esther Okoronkwo play am but Cameroon goalkeeper catch di ball.
65' Cornerkick for Cameroon demplay am but mnotin comeout, Cameroon attack Nigeria again wit counter but e nd for Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie hand.
61' Double substitution for Nigeria Christy Ucheibe don comot and Tony Payne don enta.
61' Nigeria dey attack Cameroon back to back as dem dey find goal but Cameroon goalkeeper na di weapon against di Super Falcons.
58' Save! Cameroon goalkeeper Michaely deny Nigeria anoda chance to score, she jump catch di shot from di Nigerian goal attempt.
56' Yellow card for Cameroon.
56' Chance for Nigeria but Cameroon keeper save di ball again.
56' Substitution for Cameroon Ndzana don comot, Doudou don replace her.
54' Save! Cameroon goalkeeperMichaely save Nigeria shot, e for enta inside net.
52' Freekick to Cameroon against Nigeria, Rasheedat Ajibade dey tok to referee , play don kontinu.
50' Cornerkick for Nigeria afta Uchenna Kanu and Gift Monday force di corner kick but notin comeout afta Raheedat Ajibade play am.
49' Cameroon start dis second half froom wia dem bin stop for First half so so attack and defend against Nigeria..
48' Match don kontinu as di Cameroon player dey collect greatment for di sidelines.
47' Cameroon player Nyadjou dey for ground dey receive treatment afta dshe foul hersef . She jumpto nod ball kon fall yakata for ground, she dey receive treatment.
46' Second half don start
First Half
Cameroon 1-0 Nigeria
45+4' First half don end
45+4' Since Uchenna Kanu of Nigeria enta dis game attack dey bite but Cameroon goalkeeper no give Nigeria any chance to shine.
45+2' Chance! Nigeria miss beta chance to score , Jennifer Echegini fire shot but ger leg no balance for di ball as Camerron goalkeeper run comeout to save di ball.
45' Referee add 4 minutes.
45' Nigeria play beta ball as Uchenna Kanu pass di ball to Ajibade wey try dribble Cameroon defenders but di ball enta corner kick. Dem play am but Cameroon defenders clear am again.
43' Di Super Falcons still dey struggle to get goal for dis first half but Camerron no gree. Na few minutes remain for first half to end.
40' Corner kick for Nigeria, Jennifer Echegini play am but Cameroon defenderd clear di ball wey land for Nigeria player Michelle Alozie leg but Cameroon defenders clear am out afta she fire beta shot.
39' Nigeria miss anoda chance as Gift Monday fire shot wey Michaely, Camerron goalkeeper save again.
37' Yellow card for Cameroon , Meyong Menene foul Nigeria player Jennifer Echegini.
36' Camerroon dey press Nigeria but Nigeria dey try hold dem till maybe half-time.
34' Nigeria go upfront Cameroon goal area but dem neva fit put ball behind di net.
32' Cameroon dey press Nigeria neck for di match so far but Nigeria no dey give up as dem dey hustle to get dia first goal.
30' Chance for Nigeria, Rinsola Babajide of Nigeria pass di ball to Jennifer Echegine wey fire di shot toward di goal post but Camerron goalkeeper save di shot again.
28' Camerron dey give Nigeria bad tackles as dem dey try win di ball, Nigeria too dey return di favour to Cameroon.
25' Match don kontinue afta a small pause, Cameroon dey worry Nigeria well-well for di midfield and dem dey try counter attack to get dia second goal.
23' Di tempo of di match don increase as Nigeria dey find evriway possible to score. Michelle Alozie dey ground as medical team dey attend to her.
21' Chance for Nigeria to equalise but Gift Monday miss di chance as Camerron goalkeeper save di ball.
Cameroon 1-0 Nigeria
19' GOALLLLLL for Cameroon, Nyadjou score from di freekick. She fire di shot wey beat Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie.
18' Freekick for Cameroon afta Nigeria player foul Cameroon player.
16' So far Cameroon get more ballpossession more dan Nigeria, Cameroon dey worry Nigeria for midfeld.
14' Yellow card for Michelle Alozie, she tackle Camerron player , Camerron get freekick but notin comeout from am.
13' Match don tie wrapper as Cameroon and Nigeria dey drag ball for di midfield.
10' Afta plenti camera angle reviews match don kontinue and Nigeria resume wit dia control for di ball.
9' Cameroon players get small chance foe di game to play ball but dem end up wit serious tackle against Nigeria defender Christy Ucheibe.
3' Nigeria dey dominate play for di past three minutes wey dis match start.
2'Chance for Nigeria but Cameroon goalkeeper Michaely punch di ball to safety, Nigeria get anoda chance wen Rinsola Babajide fire shot nut goalkeeper save am again.
1' Referee blow whistle and match don start
Line ups
Cameroon starting 11:Michaely, Mayikith, Tokonjoya, Mendoua.g, Naomi Eto, Ngah Manga, C. Meyong, Ngock, C. Ndzana, M. Nyadjou, Makana
Nigeria starting 11. Nnadozie, Babajide, Ohale, Ucheibe, Echegini, Abiodun, Demehin, Monday, Ajibade Oladipo, Alozie










