US musician Oliver Tree die for helicopter crash for Brazil

Tree hold piano, e wear pink and purple dress

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tree dey known for hits wey include Life Goes On, Miss You and Alien Boy, plus im 2023 collaboration wit KSI titled Voices
Published
Read am in 3 mins

Alt-pop US musician and internet personality Oliver Tree dey among di six pipo wey die wen di helicopter e bin dey travel inside jam anoda one for Brazil.

Di 32-year-old bin dey on world tour wen di accident happun for Rio de Janeiro on Sunday.

One of di helicopters later fall inside di car park of one car dealer, wey burn around 20 cars.

Videos wey Brazilian media publish show as one of di helicopters dey drop from di sky, and as flames and thick smoke dey rise from di crash site.

Authorities say dem don begin investigation into di cause of di collision.

Di Military Fire Department of di State of Rio de Janeiro say na around 09:00 local time (12:00 GMT) dem call dem to di crash site.

Belief dey say Argentine content creator Gaspar Prim Diaz – wey pipo sabi as Gaspi – na one of di pipo wey also dey for di helicopters, according to di Associated Press.

Di oda passengers on di helicopter manifest na Lucas Brito Chaves, Lucas Vignale and pilot Alexandre Souza.

Di crew manifest for di second aircraft list only di pilot, Charles Marsillac.

Who be Oliver Tree Nickel

Dem born Oliver Tree Nickell for Santa Cruz, California for 1993.

E first rise to fame for 2016 afta e go viral on social media.

Wit im distinctive bowl haircut, e dey known for hits wey include Life Goes On, Miss You and Alien Boy.

Tree bin just begin im world tour wit im most recent show for São Paulo, Brazil on 6 June.

E bin dey scheduled next to perform for Lisbon, for Portugal, on 1 July and e bin dey due to play dates for Glasgow, Manchester and London for September.

YouTuber KSI, wey collabo wit am on di track Voices, bin pay emotional tribute.

For one post wey e share on X, Britain Got Talent judge KSI say: "I no fit believe I actually gatz type dis. You be 32 man. You suppose still dey hia. You still get so much life to live. So much music to make. So much content to make.

"You be legend and go always be a legend. Still no feel real. Genuinely feel sick. I love you bro."

Jackass star Steve-O, real name Stephen Glover, also pay tribute to di late singer online, e share foto of di two of dem togeda.

"I dey veri lucky to bicom friends wit Oliver Tree," e write.

"E go check on me regularly and let me know say e care about how I dey do. Such a great pesin... I go miss am."

Dem nominate Tree for one Brit Award for 2024 for im song Miss You, alongside German producer Robin Schulz.

For 2020, e break di Guinness world record for building di largest kick scooter for 4.16m tall and 3.13m long.