Ronaldo marry longtime partner afta almost 10 years relationship

Wia dis foto come from, Jeff Kravitz/FilmMagic
Cristiano Ronaldo don marry im longtime partner Georgina afta 10 years of relationship.
Di Portuguese soccer star, 41, tie di knot wit, model Georgina Rodríguez, for one civil ceremony on August 11, 2026 for Cascais, Portugal, according to one press release.
Di ceremony na "private and intimate moment" wey dia five children attend.
Ronaldo share foto of di couple hands wit dia wedding bands wit di caption: "C❤️G".
Di wedding come one year afta Rodríguez, 32, bin announce dia engagement ontop Instagram on 11 August 2025.
She share picture of her hand over Ronaldo own, wey offer a close-up look at her ogbonge, oval-shaped diamond sparkler.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
"Sí, quiero. En esta y en todas mis vidas," Rodríguez write for di caption, wey mean, "Yes, I do. For dis and in all my life."
Di couple get five children: twins Eva Maria and Mateo, 9, daughter Alana, 8, daughter Bella, 4, and 16-year-old son Cristiano Jr., wey Ronaldo get for im former relationship.
Ronaldo first meet Rodríguez wen she bin dey work as a sales assistant for one Gucci store in 2017.
Dat January, di two make dia red carpet debut for di Best FIFA Football Awards in Zurich.
By May, dem make tins official for dia Instagram wen Ronaldo post photo of imself and Rodríguez.
For Rodríguez 2022 Netflix reality series, I Am Georgina, Ronaldo open up about di early days of dia romance.
Di athlete say e see Rodríguez as "very interesting girl, so much more mature for her age," but say e bin no expect di romance to last.









