At least 132 die for Colombia largest earthquake in many years
- Author, José Carlos Cueto
- Role, BBC News Mundo correspondent
- Reporting from, Bogotá
- Author, Vanessa Buschschlüter
- Role, Latin America online editor
- Author, Michael Sheils McNamee
- Published
- Read am in 5 mins
At least 132 people don die and dem don declare state of emergency afta one of di largest earthquakes for many years hit Colombia.
Di death toll be like wetin go increase, wit fear say more pipo still trap under collapsed buildings.
Di magnitude 7.4 quake strike at 07:34 (12:34 GMT) at a depth of 103km (64 miles) for Chocó province, di kontri geological service tok.
Dem feel am across one big area, wey stretch for hundreds of miles across western Colombia.
Many of di deaths happun for di city of Pereira, for Colombia coffee-growing region, wit surrounding cities and di Valle del Cauca region also get serious hit.
Di main location of di quake na near di village of San José del Palmar, for Chocó province, but local mayor León Fabio Marín Moncada say miraculously dem never record any death or injuries – despite say di roads in and out wey damage.
More dan 480 pipo na im don wunjure for di quakes, Colombia Association of Capital Cities write for statement update on Monday.
About 55km (34 miles) from di epicenter of di earthquake, di city of Pereira see some of di worst damage.
Videos wey BBC verify show at least one building wey collapse for Plaza Bolívar, di city main square, wit debris and dust wey scatter across di open space wia many pipo bin gather.
Local authorities don report say at least 40 pipo die for di city metropolitan area, wit 65 collapsed buildings. Believe be say pipo still trap inside 15 of dos buildings.
Curfew don already dey for some parts of di city until 05:00 local time on Tuesday.
Thirty-two buildings collapse for Cali, wey dey about 160km south of Pereira and about 200km from di epicentre.
Dan Cutler, 29, wey from London but don dey Colombia for about two months as part of a big trip wit im partner, and currently dey Cali.
For earthquake to wake pesin, e tell di BBC: "I neva experience anytin like am."
"We run outside wit our pyjamas. Major structural damage no happun to di hotel, but you fit see surface cracks for di walls, and paint and plaster don peel off," e tok.
Tori of deaths also come out from Manizales, Quibdó, Medellín, across di Chocó and Valle del Cauca regions.

Wia dis foto come from, EPA
At least two na im die for Manizales.
Angélica Ávila tell di BBC World Service say she don dey stay for di hotel for Manizales.
She say as di earthquake hit, cracks appear for di walls.
"Evri body just dey shout... I see dust dey come out of di neighbouring buildings, and bricks dey fall comot from walls," she tok.
Journalist and meteorologist Luis Felipe Molina, from Manizales, dey for house wen di earthquake strike - about 150km from di epicentre.
E explain say sake of earthquakes wey don happun bifor, di city get "very strict seismic-resistant building regulations" - so im building fit resist di impact.
"I get 450 books and na only small still dey stand ontop di shelves. You fit hear glass dey break and pipo dey shout," e tell BBC Mundo.
"Na terrible and terrifying experience."
Di kontri aviation authority don report damage for many regional airports, including di ones wey dey Pereira, Manizales, Quibdó, Armenia, Cartago and Buenaventura.
For di capital, Bogotá, trees and traffic lights shake seriously, wit tori of cracks for buildings but so far no serious damage don happun to di infrastructure.
Dem feel tremors for neighbouring Venezuela wey far, Ecuador and Panama.
Di quake come less dan two months afta twin quakes finish di north of Venezuela, wey kill more dan 6,300 pipo.

Wia dis foto come from, Reuters

Colombia President Abelardo de la Espriella don declare national disaster situation, and create special powers to react to di emergency, including to reallocate budgets.
As pesin wey just take up di role on Friday, di new president don immediately dey face potential legacy event wey fit define im legacy.
Along wit di dead, e confam say more dan 1,500 homes don damage.
As di level of di damage do start to show, world leaders don begin come front to offer support.
US Secretary of State Marco Rubio say dem dey "closely monitor" di earthquake, and stand "ready to support", while EU chief Ursula von der Leyen say dem dey use di EU Copernicus satellite for di rescue operation.
Di President of El Salvador, Nayib Bukele, send a message of solidarity to di Colombian pipo and offer personnel and equipment for rescue efforts.
According to di US Geological Survey, an estimated 1.5 million pipo feel di shaking close to magnitude seven.
Dem say di deep earthquakes, like di one wey hit on Monday, no dey too dangerous pass earthquakes wey break close to di surface of di Earth.
But dem fit release energy in a way wey fit damage buildings, wit smaller but potentially stronger aftershocks.

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, REUTERS/Luisa Gonzalez








