Why US support Chad afta dem join Mali, Niger and Burkina Faso to withdraw from ICC

Wia dis foto come from, Aytac Unal/Anadolu Agency via Getty Images
Di United States don welcome di decision by Chad to withdraw from di International Criminal Court (ICC) as dem describe dem as "flawed institution".
Inside one statement on top social media, di US Bureau for African Affairs tok say di move by di central African kontri na step to reclaim dia sovereignty as oda kontris don do.
"Di US neva go surrender our sovereignty to any global tribunal wey no dey accountable."
Dem add say di American authorities go soon launch "ogbonge campaign to end di illegal overreach of di ICC."
Chad under dia leader Mahamat Déby, bin announce on Monday say dem dey withdraw from di ICC, sake of wetin dem describe as dia "limited and unequal" effectiveness.
Dem also reject wetin dem tok say na di bias investigation, prosecution and detention dem dey do for kontris for di global south especially Africa, compared to di rest of di world.
Authorities for Chad tok say dem tink about dis decision well well, wey dem insist say dia kontri neva dey involved for any crimes against humanity or war crimes.
Di move bin happun at di time di US govment bin dey put pressure against di ICC.
Why Chad dey withdraw from ICC
On 23 July, Chad Foreign minister bin tok to di US Assistant Secretary of State for African Affairs Frank Garcia, wey di two parties bin discus di ICC.
"Di American side don express dia concern about how di ICC dey work wey dem request say make Chad chook eye again for dia membership to di Rome Statute," di statement tok.
Few days later, Chad don formally notify di UN Secretary General about dia decision to quit di tribunal wey dem create for 2002.
"Dia effectiveness remain limited and uneven in relation to di expectations wey accompany dia creation," Chad tok.
Dem also tok say di ICC dey bias against Africa kontris wey "dis kontris and populations increasingly dey view dis as form of political instrumentalisation of di ICC."
E also add say make di African Union reflect on ways to strengthen di continent judicial mechanisms wey respect African and national sovereignty.
As di US dey continue dia campaign against di ICC, di tribunal also dey face internal wahala; dem now dey search new chief prosecutor afta di dismissal of Karim Khan.
For September 2025, three West African kontris announce withdrawal from di International Criminal Court (ICC).
Burkina Faso, Mali and Niger announce dia decision to withdraw from di ICC wit immediate effect.
Na June 2026, Niger officially submit request to withdraw from di ICC, nine months afta dem announce dia intention to comot.
Dem allege say di judicial body na tool for "neo-colonialism" and dem dey practice "selective justice".
E dey clear say di Central African nation decision dey follow similar move di three junta-led Sahel nations of Mali, Niger, and Burkina Faso.
Wen Chad withdrawal go take effect
According to di Public Affairs Unit of di International Criminal Court ICC response, dem refer to Article 127(1) of di Rome Statute, wey state say di withdrawals go take effect one year afta di date wey dem receive di notice of withdrawal.
Di ICC tok say even though to join or comot from di treaty na sovereign right and decision from di kontri under international law, dem dey always regret any decision to comot from di collective effort to end impunity for di most serious international crimes.

Wia dis foto come from, SIMONA GRANATI-CORBIS/GETTY IMAGES
Why di US dey campaign against di ICC and wetin di withdrawals mean for di tribunal?
Executive director for di Jatikay Center for Human Security and Peace Building, Adib Saani bin explain to BBC News Pidgin wetin dis witdrawals mean.
- Why dis witdrawals?
According to di security analyst, "dis withdrawals be about di growing revolt against di post-Cold war international order."
"Di Sahel bin dey send message say dem no longer want international justice to be perceived as justice wey dem impose from outside."
Oga Adib Saani explain say "for dis govments, dis exits from di ICC be political statement, just as ibi about sovereignty and legal decision."
Im add say weda dis exit dey justified or not, many African govments believe say ICC bin get "credibility problem".
"Dis kontris also dey in di middle of war against terrorism. Allegations don dey about extra-judicial killing of civilians for Mali and Burkina Faso, i tin say dis withdrawals be safeguard against future prosecution," oga Adib Saani tok BBC News Pidgin.
- Why di US dey support and campaign for withdrawals?
Di US already show dia disappointment for di ICC, na so dem begin ogbonge campaign against di tribunal.
Dem ask oda kontris to comot fro di tribunal to protect dia sovereignty.
But security analyst Adib Saani say di US position for dis mata no really clear sake of dem neva dey part of di ICC bifor.
"E dey ironic say di most powerful democracy for di world dey encourage oda kontris to comot di court wey dey demserf dem neva join."
Adib Saani say "di US position for dis mata no really be about Africa, but more about dia own long-standing discomfort wit any international court wey fit scrutinise dia citizens or allies especially Israel."
- Wetin be di implication of dis withdrawals on di ICC itserf?
"Di ICC dey face di biggest legitimacy test since dia establishment for 2002, dem fit survive dis legally but politically, di ICC dey face risk of islolation," Adib Saani tok.
"Di greatest threat to di ICC no be di number of kontris wey dey withdraw, but di confidence for dia impartiality, wey dey vanish."
Di sabi pesin tok BBC News Pidgin say "every withdrawal bin chip away di moral authority of di court, even if e no dey weaken dia legal powers."
Im explain further say "di ICC neva dey need to lose majority of im members to face legitimacy crisis, dem only need enough kontris to make corperation difficult."
"Dis be sake of di fact say kontris dey make up di ICC, without dem, ICC go become yet anoda extinct global entity."









