Norway Princess Astrid die two days afta she attend her broda King Harald burial

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Henri Astier
- Published
- Read am in 3 mins
Princess Astrid of Norway, wey be di sister of di late King Harald V, don die at di age of 94, two days afta she go im burial.
Dis na announcement from di kontri royal palace.
Di new king, Haakon VIII tok say "for her long life, Princess Astrid bin rep di Royal House for warm and dutiful way".
Harald bin die last month at di age of 89 afta more dan 35 years as king. Im burial na di last public engagement wey Astrid do.
Di princess go dey buried wit state money and all ova Norway dem go fly flag for half-mast, na wetin Prime Minister Jonas Gahr Støre tok.
Astrid na di last surviving pikin of King Olav V, wey bin reign from 1957 to 1991.
She bicom first lady for Norway for di age of 22 for 1954, afta di death of her mama Crown Princess Märtha.
Olav no marry again so she get di title till her broda come marry for 1968.
Her nephew King Haakon tok say, "for her work, Princess Astrid bin dey chook eye for care and inclusion for di most vulnerable for society".
Her health don dey go down for di recent months, and for March she bin dey collect hospital treatment for pneumonia.
Plenti European royals and heads of states bin go Herald burial on Wednesday. Di pipo wey attend include di Prince of Wales and three Nordic kings.
Thousands of pipo bin dey di road wia procession from royal palace to Oslo Cathedral bin waka on Wednesday afternoon.
Di non roysl leaders wey pay dia respects na Ukrainian President Volodymyr Zelensky, German President Frank-Walter Steinmeier and five foreign prime ministers.

Wia dis foto come from, EPA
For di last months of Herald life, Norway royal family boin face personal wahala.
Earlier dis year, documents show say King Haakon wife, Queen Mette-Marit, bin dey relate regularly wit US sex offender Jeffrey Epstein. She later comot say she wish say she no eva meet am.
Meanwhile, her pikin from anoda relationship, Marius Borg Høiby wey no be royalty even though e grow for dia collect four years in prison for two cout of rape charges for June.
Dem give Høiby, wey bin dey under house arrest till appeal, permission make e go di burial.

Wia dis foto come from, Norway's royal house








